Barnz Agev - life no balance

Поделиться
HTML-код
  • Опубликовано: 10 сен 2024
  • Roll, roll , roll your tyre
    Gently down the street
    Just dey roll am jeje jeje
    This Life no balance
    Make I no lie 4u, this life no balance
    Na why even if u settle down make plans something go come scatter ur plans
    I go advise u make u no dey hard on yourself, Take life easy
    No dey blame urself if things no work out as u plan
    Na so life be, e no balance
    Na why person apply Medicine and surgery for University them give am biology education, e graduate dey work for bank,
    Another person study banking and finance na taxi e dey drive
    Person spend 5yrs for school study engineering only for d person to end up as blogger
    Another person study English but e dey work for engineering company
    The life no just balance,
    Them dey beg person mk e chop food e dey refuse
    Another person dey beg mk them give am food to chop them dey refuse
    E d mk me ask questions wey no get answers
    Wetin person go do
    If u try to put in more effort them go say you dey overdo
    If you say mk you dey on the low them say you too lazy u no dey try atall
    Nothing u fit do to balance d scale
    Las Las ba, I go advice u mk u leave am for God, na him create life, him know wetin to put and wetin to remove from d scale to make the life balance
    But for the fact say life no balance e no mean say mk u sit down fold ur hands, do d one wey u fit do, leave d remaining one for God
    This talk so, e get why

Комментарии • 24